Written by Snakie86, (Snakie86@gmail.com) (5C350257)…
I entered inside our flat and all my friends were already waiting for me
Kay: Chairman……………….Powerful chairman
Micheal: Na the oga be this now ooo
Gbenga: Hope u bought milk on ur way coming…………….cos I know say u go don loose too much energy today, e no easy at all after so many months without S#x
Kay:Hope say u use condom sha cos this one no be shade ooo
Gbenga: Baba ooo……but wetyn make u late now, u follow the babe go house?
Me:which kind house, jst gisting at the bus stop ni……………..
Gbenga: But that babe make sense oo……
Micheal: I no say as she fair nah in her Kitty-Cat sef go fair cos her complexion no be from here
Kay:lailai…down go dey dark..na bushy area now…how d tyn take b?
Me:Na clean shave now…..no traffic at all
Gbenga: baba ooooo…..u suppose wash am for us ooo
Me:wash wetyn now……………………..
Gbenga: ahn..ahn……………you are welcome to the league now, so u suppose carry us go shaye for iya uche place
Kay:na tru ooo..we no go even spend reach 5k sef…wetyn we wan drink
Me:una dey craze..bleeping na achievement
Micheal:Na achievement for your own case ooo…..how many months now wey u don do am last
Abimbola: Nonsense…………….(she hissed and walk inside the room)
Kay:wetyn dey do this one now…u no even happy for your guy say e don break the jinx now….
Gbenga:No mind the babe, sebi snakie dey beg am for babe all this while she dey do shakara, the guy come run hin own package now she dey hiss dey call am nonsense…..
Me:I even dey hungry sef
Kay: E reach like dat my chairman……….Abimbola, abeg prepare food for us to eat ooo, your children are hungry
Abimbola: Children should go and drink water
Me:water ke? Abeg no do like that oooo
Abimbola: Who dey talk to u? u wan eat poison? U go just die for notyn…….bird of same feather
Gbenga: wetyn happen now Bimbola…….Na fyt?
Kay: I no no 4 am oooo
Abimbola: even if I wan cook for everybody, snakie no dey eat my food again ooo
Me: wetyn I do now….na beg I dey beg pls
Tunde: why u dey beg am now……………….
Micheal: hin need d food dis nyt more dan any other day..so, he gatz beg
Abimbola: If snakie dey eat den I no dey cook again b dat…………….
Gbenga: up to dat?
Abimbola: e even pass dat sef…………….Ashewo oshi
I left them in the sitting room to take my bath, I finished with my bath and Abimbola was already in the kitchen….food was ready in no time, she served everybody and didn’t give me any food..i went to the kitchen when they started eating to dish my own food….i was putting food on my plate when Abimbola rushed into the kitchen and collected the food from me……………
Abimbola: Na u cook am? Why u no ask your girlfriend make she cook 4u before she go abi na me collect all ur energy……………….
Me: Pls now…no do like dat now
Abimbola: Like wetyn……………..Monkey dey work, baboon dey chop am
Kay: Who be monkey and who be baboon
Abimbola: I no no 4 una oooo…….i go dey cook for una and una go dey waste am to somewhere else, I no even expect am to this snakie, I thought he was different from you guys before but he proved me wrong today….As from today ehn, any day wey any of una bleep any lady for this house aside una main girlfriend, no food for that person for this house dat day……………
Micheal: oya now……Mama don talk….una don hear ooo
Me:Atleast make I carry dis one now, sebi na today u make the law
Abimbola: e don start today b dat…Idiot
I realized Abimbola was not joking with me even though my other guys count it as joke cos on my mind, I know she wont be happy with wat she saw. I picked another plate and she collected it back from me, I was looking at her with pity as she stared at me with a strong face….i drew her closer with my right hand placing her back on the wall with a kiss to her lips forcefully, she removed her mouth, I knelt down holding her bottom
Me:Pls am very sorry Abimbola, I will explain everytyn to you when we are alone
Abimbola: Sorry for yourself abeg, I don’t have your tym
Me:Pls am sorry now babe
Abimbola: Notyn to be sorry about, I thought u are different before but never know u are the same thing with other guys……………………
I could feel it as tears wanted to started rolling out of her eyes, she clean herself, adjusted, pushed me away and stepped out of the kitchen. I dished my food and went back to the sitting room. I tried to talk to Bimbola later in the night when we were a bit free but she never gave me any chance.
I received a text message from Labake later in the night telling me she cant wait to see me tomorrow that she was missing me already………….(When one door closes, another one open)
To Be Continued…
from Hot Leaked Videos , Gists, News Updated 247 http://ift.tt/1Vxfbw6
via IFTTT
EmoticonEmoticon